Plenty people been dey think say goal go brekete lass nite wen Arsenal and Liverpool jam diasef for BPL game, but na 0-0 na hin de two teams take finish de match for de Emirates Stadium.
De match sweet well well like pami as all de fans wey watch am enjoy de game even though goal no gree enta net for de game.
Arsenal fans kon dey hail dia golkipa, Petr Cech sake of say de guyman no gree make Chelsea strika, Christian Benteke score.
Walahi Liverpool see beta ball play well well for de fess half, and na even two goals na hin dem suppose score sef if no be Petr Cech wey save Arsenal plus de woodwork.
Na for de second half na hin Arsenal kon begin dey tap beta ball, but Liverpool no gree open yarns for dem as dem no gree make dem score.
Liverpool fans also suppose buy beta pepper soup for dia golkipa, Simon Mignolet becos na de guy no gree make Giroud score de shot wey hin play.
Wen de match remain few minute wey refiree go blow final wisu, naso Chamberlain and Walcott kon carry ball dey run like cheetah, but Liverpool defenda, Martin Skrtel jam dem like trailer and naso de match take finish 0-0.
Clips from Arsenal vs Liverpool |
No comments:
Post a Comment